BBC Pidgin has you covered with the Robinson x lover text messages.
Di man wey dem suspect say kill conservative commentator Charlie Kirk bin text im roommate afta di shooting to discuss possible motive, according to court documents.
www.bbc.com
Robinson: drop wetin you dey do, look under my keyboard.
[Wen di roommate look under di keyboard, one note dey dia wey allegedly read: "I don get di opportunity to take out Charlie Kirk and I go take am."]
Roommate: "What?????????????? You dey joke, right????
Robinson: I still dey ok my love, but I dey stuck for Orem for sometimes. E no go take long, until I reach house, but I need to pick my riffle. To be honest I bin dey hope to keep dis secret till I die of old age. I dey sorry to involve you.
Roommate: No be you do am right????
Robinson: Na me, I dey sorry
Roommate: I tink say dem don catch di pesin?
Robinson: no, dem grab one crazy old dude, dem later interrogate pesin wey wear same cloth like my own. I don plan to grab my rifle from my drop point shortly afta, but dem don shutdown di area. E dey quiet, almost enough to get out, but e get one car wey still dey dia
Roommate: Why?
Robinson: Why I do am?
Roommate: Yeah
Robinson: I don get enough of im hatred. E get some hate wey you no fit just quiet dey look
Robinson: If I fit grab my rifle and nobody see me, area clear be dat wit no evidence. I go try retrieve am again, hopefully dem go don comot for dia. I neva see say dem dey find am
Roommate: How long you don dey plan to do dis tin?
Robinson: a bit ova a week I believe. I fit get close to wia di riffle dey, but e get one police car wey dey parked close to wia e dey. I tink say dem don already clear dat spot, but I no wan risk am
Robinson: I wish say I don go back and carry am as soon as I enta my car.... I dey worried, I no know wetin my old man go do if I no bring back grandpa rifle ... I no know if e get serial number, but dem no go trace am to me. I dey worry about prints, I leave am for one bush, wia I change my dress. Time no dey to carry am... I get to leave am and hope say dem no go find prints. how I go take explain give my old man say I don lost di riffle....
Di only tin I drop na di riffle wey I wrap for inside towel...
remember how I bin dey write on di bullets? Di [coded] messages na mostly one big meme, if I see "e notice bulge uwu" on fox new I fit get stroke alright I go leave am, e really [expletive] suck.... judging from today I go say grandpa gun dey work well-well idk.. I tink e buy am for $2k scope;-;
Robinson: delete dis exchange
Robinson: my dad want fotos of di rifle ... e say grandpa wan know who get what, di feds don release foto of di gun
Robinson: since trump enta office [my dad] don turn pretty diehard maga.
Robinson: I go turn myself in willingly, one of my neighbours here na deputy for di sheriff.
Robinson: Na only you I dey worry about love
Roommate: Na me worry about you pass
Robinson: no follow media please. no grant any interview or make any comments.... if any police ask you question ask for lawyer and stay silent.